Saturday 9 April 2016

Patience Jonathan explains the reason she danced and held tight to Obansajo



Former First lady, Patience Jonathan dancing with ex-President Olusegun Obasanjo in Abakaliki few days ago


Read the interview in pidgin english as gathered by Sahara reporters:

Hello, this is Jebose. Can I help you?
Eh, Jebose, na who you dey yarn Amerikana for. You nor sabi my namba again. Oloshi.
Hehehe. My mommy. The mommy of all mommies.

Gerraautt. Who be your mommy. Your mama dey for una Onicha Ugbo grave. I beg nor mommy me.

Mommyyyy… you mellow this morning o. Hope nothing dey pa?.How far mommy. This one wey you call me so for early mor mor
Sharraap. You nor happy I call you?. I hia say you rite buku say Waiting for my hosbans to die. Na which womans dey wait for
im hosbans to peme?. Na wa for you and dat buku. You go sell so?

Haba madam. How you take don hia nah… I be wan ask make you waka come be Chief Launcher na! But you jus comot word for my mouth
Dat your smelly smelly maut. You dey aks me who tells me. You forget say I be fes lady. I dey hia eferythins about my friends

Eyyaaahh!!! So I be your friend. You come leave me go waka dey dance with baba Iyabo. Na wa o, madam. You fall my hand sha. Friends don’t let friends dance with retired Presidents na.

Jebose if I slap you?. Idiot. I say you be nonsense pikins. Scaliwag like you. Make me I dance with you?. Church rat of Onicha Ugbo. Hmmm. It is not your folt o. I swear. Na me carry my Etisalat begin call your yeye China made Nokia flipu fone. Alakoba

Madam the tin wey pain me be say you come dey hold baba iyabo tight sef for dance floor. I beg where Oga Jonathan dey wey you dey tap agbalagba current?

Oloriburuku omo ale. If i hole am nkor. Na only me waka come nah. Jebose, wetin konsan you if i dance hole tait with Daddi Iyabo. I say wetin konsan you. You nor be my hosbans. Or you be my boi frens?.Mscheeww.. which kain korent you say I tabu… baba nor get korent o.

That's politics where there is no permanent friend or enemy

No comments:

Post a Comment